Posts

Showing posts from May, 2021

Davido Buy Range Rover SUV For Im Daughter

Image
Dis kind gist dey totori wella. To be father no be beans. Davido don enter news matter as a godfather wey dey see road. No be small tin o. I dey hail Davido for di way wey him dey use carry him pikin dem along. Some other celebrities no dey try when e come to matter of their children. "Happy early BIRTHDAY BABY  @realimadeadeleke  daddy loves u !! Enjoy ur MOTO ❤️❤️❤️❤️❤️❤️,"  na di title of I'm Instagram video. Check out Davido Instagram Page Na for him Instagram page wey Davido post di video wey him dey present di moto to im daughter to mark her birthday. 

Bill And Melinda Gates Don Divorce

Image
According to BBC , dem bin don dey married for 27 years now. Dis one shock di whole world unto say no body know say dem marriage no dey go well again.  As of now we still dey wait to hear di main gist, becos na after now wey some small-small tori go begin come out.  Na person wey know dem house-girl go get di real, full gist. Last-last, e don happen.  Una do o.

Davido Enter Twitter Go Drop Cold message To Him Fiancée, Chioma On Her Birthday

Image
Dem say one day monkey go go market, e no go come back. Davido and Chioma monkey neva come back o, becos na 'Mama Ify' be di name wey Davido call im babe on twitter on her birthday last Friday o. No more assurance?  Di matter don dey even trend on twitter sef after pipo see how Davido take hail Chioma.