Princess Say CCTV catch actor as him dey try to molest small girl, 7 Years After Him Defile Her
According to Pulse.Ng, Princess say di CCTV catch am as im dey try to molest the child.
Inside her video we she post today, na cry wey comedian, Princess take tok how di actor bin don defile dis same girl when she bin dey 7 years old.
She tok about how when her marriage no work out, some parents bin allow their children to go stay with her so she no go dey feel lonely.
"I have read and heard a lot over the last few days. I don't wish anyone to go through what I'm going through. Some years ago I had challenges in my marriage and some parents in my area out of compassion allowed their children to stay with me so that I won't feel lonely," na so she tok.
"There were six of them - 3 boys and 3 girls. Baba Ijesha had some challenges and came to me for help. I enrolled him for GCE. That day, he came for more help and I was at home."
She come tok how na when dis man bin come her house dat time wey him defile di small girl come warn her say make she no tell any body.
"He even came the next day to be sure that she didn't tell anyone. He told her that he brought fruits that she should come downstairs to pick them. When she followed him down, he used his key to defile her,"
Princess say na 7 years later wey the pikin come tell her wetin Baba Ijesha bin do.
"I sent him a DM, told him that I had a movie to shoot so he should come to the house. While he was on his way I told CCTV company to come and fix a camera, because I remembered what my sister told me that if we do not have evidence, people will think we want to set Baba Ijesha up," na so she tok.
She come tok how this man come again, come try to molest this same pikin again. Na so dem sharply call police wey come arrest him.
If you remember, police bin arrest Baba Ijesha last week for defiling a 14 year old girl.
Police don tok say the actor con confess say him bin defile di girl.
Which Princess Instagram video:
Comments
Post a Comment