Koolobi
If you Koolobi me, I go Koolobi you. No matter how tins dey for front, frog no go jump go back. Na only front e go jump enter.
This blog different wella. If you no sharp, you go loss as you dey read. Dem dey call my write-ups "if you blink, you miss".
Na wetin com be the meaning of Koolobi?(I don change topic).
Koolobi na word wey mean plenty tins. One way wey we dey use am, na to describe when persin collect something from another persin.
For example, persin fit say "oboy dat man koolobi my phone o".
The Koolobi we dey yarn for here na about lifestyle, dat na anyhow wey you wan live ya life. From music to sports, Nollywood to education, fashion to market, politics to religion. Everything dey inside the matter.
Wetin we go dey do here na to ask you how e dey be for your area and wetin be your opinion about the matter dem wey we go dey touch-light(dat means matter we go dey discuss).
We go dey also give out small small gifts like cash, recharge cards, phone and all the better better tins dem wey dey make our everyday life sweet.
Without wasting too much of your time, my name na Tavie Okolobi.
Hold ya side.
Comments
Post a Comment