Dem Wan Auction The Oldest Bottle Of Whiskey For This World
According to Tekno, e don tey wey we dey shayo....since 1960 oyoyo....you already know the song.
As e don carry be, the oldest bottle of bourbon whiskey fit be your own. Yes o. If you wan shayo di kind of shayo wey old like your ancestors and you get extra $20,000, na your opportunity be dis.
Na for inside Georgia for US dem bin package this whiskey keep, and now, e don ready for auction. See eh, no whiskey old pass dis one, na so di pipo wey dey organize the auction take tok.
Dem don set the auction for June 22-30 and dem dey expect pipo wey wan price am to ready to price between $20,000-$40,000. Na so di pipo wey dey arrange di auction take tok last week.
According to di University of Georgia, dem say pipo bin don produce dis shayo between 1762 - 1802, during the US Revolutionary war.
Many pipo don keep dis drink since that time and now, e don ready to enter another person hand.
If na me buy am, I go drink am finish, make e for no loss. Lol.
E get any body for Naija wey don package kai-kai keep for the next generation to drink?
You know of any body wey arrange drink keep for many years?
Comments
Post a Comment