Make We Pray For Imo State
Make we pray for Imo State.
Di kind of bad news wey we dey hear from there don too much. E no dey allow person sleep for night again.
Like play like play, see where e don bad reach. E no good nau.
Pipo lives dey at risk every minute of the day. Seriously, make our federal government put eye inside di matter abeg. Na human beings dey live there and if our government value pipo lives, make dem take action. I no want dis tok tok becos pipo don too suffer.
I dey also call on our public figures, politicians, celebrities and influencers to join hand quench dis fire. E no matter if you from Imo State or not, na one country we from. Dat small tin you help do go really push di matter go far.
As a country, make we join hand pray together make dis nightmare end and never return.
God bless Naija.
Comments
Post a Comment