Linda Ikeji Son, Jayce Don Start School


On top of one of her new Instagram post, Linda Ikeji, one of Naija biggest bloggers and media business woman say her son, Jayce son start school. 

She also talk say e dey sweet her for bele wella as she don start to wake her pikin up every morning, come baff am, and prepare him and carry him go school and to go again after school don close to pick him up. She happy o. 

You think say Linda Ikeji nor go soon taya to do school runs one day? I say make I ask na, make e for no loss.

Every body know say she be very busy woman with a very big business wey she dey personally package. 
To tell you the truth eh, that school fees go change my destiny once once...Lol.

By the way, one comment from one of her plenty followers, pde_847  comment say "when you are big, you are big. See my house rent on Jayce's feet. God when".

Comments

Popular posts from this blog

Dem Wan Auction The Oldest Bottle Of Whiskey For This World

Lagos Govt No Gree Donate N25m To Oshodi Amputee Hawker Again Because Dem Dey Suspect Say She Dey Lie

Koolobi