J MARTINS DEY BEG FORMER PERSIDO, JONATHAN TO FORGIVE NIGERIANS

Di music star dey beg oga Jonathan to forgive all those pipo wey betray am for the end of im tenure.

Na for Instagram wey J Martins post di long post on Tuesday, April 27, 2021. No be small lament wey our brother lament o, about how pipo no dey free to tok their mind again unlike how dat one no be problem during oga Jonathan tenure.


"Jonathan Oh Jonathan🤔🤔 The freedom of speech we all enjoyed during your stay in office as president of nigeria is no longer available, yes we never valued it then sir," he wrote.

"The corruption your government was accused off then have now graduated with a double PhD in this prestigious government and yet they've kept a blind eye thinking that they will all go free? even if they leave government today? Nope never!"

"There is no part of this country that's not under attack, if not banditry, it's kidnapping, or boko haram or killing of security officers, this things were never heard off before but now it is our every day living experience."

Him no stop there o, na so im fire all di pipo dem wey bin betray the former presido when im bin really need their support.

"Oh Jonathan i know you were called all sorts of names, those who betrayed you some of them are dead while many of them have no shame, they're still busy jumping from one political party to another, the few others can not look at you in the face because they failed to learn from judas who betrayed his master," he added.

"I know you would say you're not a pastor but you're a Father and fathers blessings go a long way in helping his children succeed sir, please and please sir, do this for us all."

The music star post na becos of di unrest wey pipo dey experience inside all Naija.


Check out the Instagram post: https://www.instagram.com/p/COJ_oDEM3m7/?utm_source=ig_web_copy_link

Comments

Popular posts from this blog

Dem Wan Auction The Oldest Bottle Of Whiskey For This World

Lagos Govt No Gree Donate N25m To Oshodi Amputee Hawker Again Because Dem Dey Suspect Say She Dey Lie

Koolobi